avatar

Member

directonpc

Psalm 23 in pidgin English

(Nov 22 2015 at 08:36am)

Psalm 23 in Pidgin English:
1. The Lord na my shepherd, I dey
kampe.
2. E make me sidon for where better dey flow yanfu yanfu. And come put
me next to stream make my body
thermocool.
3. E panel beat my soul come spray am white, come dey lead me dey go
through express road of righteousness because of Hin name.
4. Walaii! If I waka pass where arm
robber, 419 and juju people boku,
come even join boko haram reach
valley of the shadow of death sef, liver no go fail me. Your rod
and staff nko?
Na so dem dey like backbone dey
comfort me.
5. You don arrange good fufu and Amala on top table make I chop. See
bad belle people dey look waa waa.
You rub me for head with vaseline
intensive lotion. My cup come be
like River Niger dey troway dey go.
6. True true, better life and mercy go dey follow me till I quench. And I go tanda for God house... lai lai I no go comot for wia better dey.
God Almighty, Na you biko! AMEN.

[1K views]


You may also Like:

Quick reply


add files