kossydiba
My phone to phone Palava(trouble)
Aug 30 2014 at 07:42am
Abeg make u no laugh, I just need una advise!
My Blackberry chop my money tire, so tey I come vex go sell
am come take some money out of the money I take sell
come buy new China phone! Hhmm!!! I don land for bigger
palava o! Make una help me see that features wey this new
China come get:
1. E go full after 3 minutes of charging.
2. The phone na touchscreen, e get TV, Flashlight, Nail cutter,
Fire lighter etc.
3. I fit write text message with toothpick sef.
4. The spelling get mistakes e.g NokLa, blackderry, i-pon,
samswag, somny election, apblo etc.
5. When aeroplane pass, e go record 'One missed Call'.
6. When a big car horn, e go show 'Charger connected'.
7. If person shout near me, e go show 'Message Received'.
8. When Chinese man pass, e go show, 'One Bluetooth device
found'.
9. When fine person waka pass, e go show, 'WiFi On'.
10. When ugly person waka pass, e go show, 'Virus detected'.
Abeg I wan sell am! Who wan buy ooo? Even as I dey find
buyer now sef, e dey show me for screen say, 'No contact
found'.